fbpx
June 17, 2024

WAEC Withhold Results Of 262,803 Candidates

waec-withhold-candidates-results-

Di West African Examinations Council, WAEC don withhold di results of 262,803 candidates wey write di 2023 school candidate West African Senior School Certificate Examination.

Patrick Areghan, di council Head of National Office, tok dis tori for news conference to announce di release of di results.

He yarn dem withhold di result in connection with different reported cases of examination malpractice.

According to wetin hin tok, di figure represent 16.29 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination.

Also, he yarn say dis one dey 6.54 per cent lower than di 22.83 per cent wey dem record for in di year 2022.

In addition, hin yarn say nowadays, candidates no longer ready to study again, dem lack self-confidence and preparations for examinations dey poor. P;entry candidates dey over-rely on so-called ‘Expo’, wey no dey exist.

 

FOR MORE NEWS: Gunmen attack traders for Plateau, one kpai

 

Also, hin tok say some candidates dey always end up frustrated when dem enter examination hall, discovered say all di thing wey de don celebrate na fake. Di council head yarn say e dey pitiable because na wetin dey lead to di failure of some candidates for di examination.

Hin add say dem don start to investigate all reported cases and reports of di investigations go dey presented to di appropriate committee of di council for consideration and final decisions.

You fit go read di tori see why WAEC withhold candidates results…READ MORE