fbpx
May 16, 2024

We no dey rig election, na politicians dey do am – INEC

INEC-

Di Independent National Electoral Commission (INEC), don maintain dia stand say room no go dey for di rigging of di 2023 general election for Ebonyi.

According to di commission, to rig di election no go easy as di commission don dey fully prepared to ensure a free, fair and credible election.

Ebonyi new Resident Electoral Commissioner, Mrs Onyeka Ugochi yarn this one for Abakaliki, di state capital for dia interactive meeting with Journalists and Civil Society Organizations (CSOs).

To rig election no come from INEC. Na di politicians outside there dey rig elections.

FOR MORE NEWS: We be one – Tinubu send greetings to hin opponents for Christmas

Na time for di media and CSOs to work very hard and make dem dey sensitive to di people. We dey open.

As REC mention say di media play important role to inform citizens about di political parties wey dey compete, candidates wey dey involved and their manifestos, she advise CSOs/Media make dem step up di Public enlightenment campaign for citizens to get dia PVCs before di 2023 general elections.

You go like go read ful tori…READ MORE