fbpx
April 25, 2024

WHO yarn say dem fit see the end of COVID-19.

0
COVID-19-WHO-confirms-the-end-

Di number of coronavirus cases wey dem don dey report (COVID-19) don drop, di World Health Organisation (WHO) na hin confam am.

Dem yarn say dem never dey for better position to end di pandemic. We never dey there yet, but we fit see di end.  WHO Director-General Tedros Ghebreyesus note this tori for di virtual press conference on Wednesday.

He tok say as of last week,di new cases of di disease wey dem don report, and wey don kill over six million people, don fall to the lowest level since March, 2020.

YOU FIT LIKE READ: Americans go pay for COVID-19 vaccine, treatments.

Mr Ghebreyesus yarn say we dey for di winning position. But now be di worst time to say we no wan run again. According to am, na now we need to run very well so that we go fit cross di line reap di rewards of all our hard work.

Hin still yarn say if we no take this opportunity, we go run di risk of more cases and more deaths, more trouble and more uncertainty so, make we seize opportunity.”

You fit CLICK HERE read more of di tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *