fbpx
December 22, 2024

Presidential election: Why I Go Personally Go Court of Appeal. – Peter Obi

why-i-wan-go-court-of-appeal-obi

Di Labour Party, LP, presidential candidate, Peter Obi on Wednesday don open up on why hin wan go di Court of Appeal.

Obi yarn say hin dey go di Appeal Court over di refusal of di Independent National Electoral Commission, INEC, to allow di LP inspect electoral materials wey dem use during di presidential election.

He tok dia matter as hin dey lament over hin inability to campaign for LP governorship candidates across di country.

Obi come third behind Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party, PDP, and di winner, Bola Tinubu of di All Progressives Congress, APC.

Following hin defeat, Peter Obi don approach court of Appeal to contest hin loss and hin ask say make dem allow am inspect materials wey INEC use during di election.

FOR MORE NEWS: Shehu Sani don caution pipo wey dey refer to di President-elect, Bola Tinubu as drug baron

However, Obi, inside series of tweets, write say hin suppose start dia whistle-stop campaign for dia various Labour Party Governorship and State Assembly Candidates today. Initially, hin trip suppose carry am go Nasarawa, Lagos, Enugu, Abia, Delta, Edo, Rivers, Plateau, Borno, etc.

“However, following INEC refusal to allow dia party to inspect di materials (including BVAS) from di 25th February presidential elections, Peter Obi go personally to Court today with hin lawyers. Na wetin Obi tok be dat.

“As we pursue due process and defer to the rule of law, I urge all the Obidients in the various states to continue campaigning for our candidates, namely, Gbadebo Rhodes Vivour in Lagos, Chijioke Edeoga in Enugu, Patrick Dakum in Plateau, Alex Otti in Abia, Ken Pela in Delta” Na wetin hin tok be dat.

Also, hin mention Ibrahim Mshelia for Borno.

In addition,  he yarn say e dey important for Obidients to vote for candidates with Competence, Character, Capacity, and Compassion.

You fit go read di read di full tori…READ MORE