fbpx
May 18, 2024

Nollywood na danger zone for young girls – Regina Daniel reveals

nollywood-na-danger-zone

Famous Nollywood actress, Regina Daniels don tok how movie producers dey take advantage of young girls for di movie industry, and she yarn say Nollywood na danger zone for young girls .

Na inside trending video wey she share for her Instagram page na hin she reveal dis matter on Tuesday. Regina narrate her encounter on set with one 14-year-old makeup artiste, wey dey go from set to set to dey work with different pipo .

Also, as she call out her colleagues wey turn blind eye to di girl for past, di actress beg dem say make demstand against child labour.

FOR MORE NEWS: “Think before you sing, wetin be 10 girls on my bed” – Portable don bash Wizkid over verse on Abracadabra remix

As Regina rescue di girl from child labour, she carry di girl enter boarding school and she dey surprised to see how well di girl pass her entrance exam.

She add say she don vow to always fight against any movie producer wey dey recruits young kids for movie roles.

Also, Regina yarn say nollywood na danger zone for young girls. And she narrate how her mama, actress Rita Daniels, during her early years for di industry bin protect her from being sexually abused by movie producers.

You fit go read di full tori…READ MORE