fbpx
May 16, 2024

Singer, Ayra Starr reply after fan compare her to Beyonce

ayra-starr-don-reply-fan-on-twitter

Nigerian sensational singer,Oyinkansola Sarah Aderibigbe, wey dey known as Ayra Starr, don reply one Twitter user fan wey compare her to Beyonce.

Di Twitter user wey dey identified as Milo, enter di microblogging platform. Inside di post, di fan claim say di 19-year-old Mavin signee Ayra Starr, dey quickly replace American singer Beyonce.

 

“Ayra Starr is slowly replacing Beyonce.” Na wetin hin tok be dat.

Interestingly, di tweet catch Ayra Starr attention, and she respond.

Reacting, Ayra Starr yarn say di Twitter user dey set her up for dragging with wetin hin tok.

“Una go just dey set me up for draggings lol”. Na wetin she tok be dat.

See below,

 

FOR MORE NEWS: “Think before you sing, wetin be 10 girls on my bed” – Portable don bash Wizkid over verse on Abracadabra remix

Also, e neva too tey wey Fast-rising Nigerian singer, Ayra Starr enter social media to reflect on her life before stardom.

Inside post via her Twitter handle on Monday, di Mavin signee, wey don make name for herself for Nigerian music industry, tok about how she start her career.

In addition, she yarn say two years ago she just be girl from Agbado Ijaiye for Lagos State. And she express her joy for how far she don come in such a short time.

Di self-proclaimed Sabi girl still yarn say she no get idea of how she go react when her hit song Rush reach 100 million views for YouTube. So far, di song don rank up to 96 million views, one of di highest viewing totals for Nigerian artiste.

“I really don’t even know what I’m gonna do when rush hits a 100 mil on YouTube, do I cry , do I jump ?? God, 2 years ago I was just a small girl from Agbado ijaiye,” Na wetin she tok be dat.

You fit go see di full tori…READ MORE