fbpx
May 7, 2024

I dare anyone to suspend me from PDP – Wike

wike-dare-pdp-leadership

Di Minister of di Federal Capital Territory, FCT, Nyesom Wike, dare di leadership of hin party, di Peoples Democratic Party, PDP, say make dem suspend or discipline am.

Wike tok dis one on Wednesday during hin interview with Channels Television Politics Today programme.

According to report, di immediate past governor of Rivers State and member of di major opposition party, PDP, bin dey sworn in as minister of FCT some days ago under di administration of President Bola Tinubu of the ruling All Progressives Congress, APC.

Also, as hin dey addressing di backslash wey hin receive following hin appointment, Wike yarn say hin bin tell PDP leadership before hin take di ministerial offer of President Tinubu.

However, Wike yarn say hin neva see any PDP chieftain wey go suspend am from di party.

 

FOR MORE NEWS: Gunfire for Gabon as soldiers seize power, cancel election result

 

When person ask am weda hin dey fear if hin party fit move against am or expel am,  Wike yarn say “Who be dat party? Who be di PDP pipo? Hin tok say wetin go make anybody talk about expelling am? A State wey don bring governor, State wey bring three senators, a state wey produce 32 members out of 32 House of Assembly and produce 11 out of 13 House of Reps.

Hin kon ask say weda di person wey go suspend am na di one wey no fit produce governor, abi di one wey no fit produce senators and Assembly?

To answer di question finally, hin yarn say hin neva see dat person with all due respect. In addition, hin tok say na hin suppose call for dia discipline for violating di party constitution.”

You fit go read di tori see why Wike dare PDP leadership…READ MORE