fbpx
May 18, 2024

“I no go refund dat money” – Ruby Orjiakor lambast Destiny Etiko

ruby-orjiakor-lambast-destiny

Ruby Orjiakor, wey be Nollywood actress, don lambast her colleague, Destiny Etiko, wey first call her out for breach of contract.

Destiny Etiko tok for inside Facebook video say she paid Ruby N700,000 to appear for one of her films, but she fail to complete di project and she no gree refund her money.

Destiny wey dey vex don promise to viciously beat Ruby Orjiakor.

In response to Destiny Etiko call, Ruby Orjiakor reveal her side of di tori on top Facebook, she tok why she bin no fit complete Destiny job.

 

FOR MORE NEWS: Students dey hail Tinubu over approval to loan bill

 

Ruby insist say she no dey fear anybody and say she no go repay di money. According to her, she don already spent everything and she go only make am up to her by appearing for subsequent Destiny Etiko film.

Also, she label Destiny Etiko as lie lie person and gossip person. She even make comment about di actress yansh surgery, wey she yarn say dey affect her brain.

Captioning di video, she write:

“DESTINY ETIKO” U’RE A FAT LI@R” AND A GOS$IP”……. I AM HUMBLE” BUT DON’T EVER TAKE IT FOR GRANTED””

You fit go read di tori as Ruby Orjiakor lambast Destiny…READ MORE