fbpx
May 4, 2024

Just in: Worker don start nationwide protest – Ajaero

NLC-yarn-say-workers-don-start-protests

Di Nigeria Labour Congress, NLC yarn say di workers and labour unions don start nationwide protests.

Na di President of NLC, Joe Ajaero, reveal dis tori on Wednesday as hin dey address pressmen for Unity Fountain, Abuja.

Workers, in dia number, wey carry placards gather to protests for di streets of FCT, Abuja.

Ajaero yarn say some hindrances dey for as dem start di protest for some states.

Hin yarn say Protests don start for all di states. Also, dem dey aware of di Police efforts to stop di process for some areas.

However, hin yarn say nothing fit stop di protest. Based on responses from state governments, hin tok say na dia determination whether di protest go be for today, tomorrow or next, no be by using force to stop di pipo from expressing dia views.

 

FOR MORE NEWS: GOAT debate: Ronnie Coleman don pick who hin like between Messi, Ronaldo

 

In addition, hin yarn say dem dey protest, to make statement to Nigerians.

Recall say workers bin announce nationwide protest on August 2 to demand a reversal of fuel price increments and other policies by President Bola Ahmed Tinubu’s government.

On Wednesday, workers start protests for Abuja, Ogun and Kano states and other parts of Naija.

You fit go read di tori see as workers don start nationwide protests…READ MORE