fbpx
May 4, 2024

FG give update on IPPIS payment challenges

fg-payroll-payment-update

Di federal government, FG don give update, dem yarn say dem dey committed to resolving all challenges with dia payroll payment system, Integrated Personnel and Payroll Information System (IPPIS).

Accountant-General of di Federation (AGF), Mrs Oluwatoyin Madein disclose dis tori inside statement wey dey issued on Sunday by Bawa Makwa, di Director of Press at OAGF.

You go remember say di federal government bin blame technical glitches for di challenges wey dem experience for salary payment.

 

FOR MORE NEWS: Kaduna Election Tribunal don adjourn sitting

 

Madein, inside meeting with IPPIS officials, give assurance of permanent solution to di payment system to avert future challenges.

According to di AGF, di OAGF dey determined to consolidate on di gains of di IPPIS and dem go work to maintain an efficient and trustworthy payroll system for di Kontri.

Also, AGF toksay dem don take notice of di challenges for IPPIS, and dem go do everything possible, not only to resolve them but to forestall future occurrence.

You fit go read di tori of FG payroll payment update…READ MORE