fbpx
April 19, 2024

World Bank don readi to invest $700m for girl child education in 19 states

0

Di World Bank Country Director for Nigeria, Shubham Chaudhuri, don come out tok say di World Bank don readi to invest di sum of $700 million for girl child education in 19 states of di country.

Hin yarn dis one on Monday, duriing one summit like dat where dem tok about how Nigeria go take get better.na Office of di Speaker, House of Representatives and di National Population Commission, supported bi di World Bank for Abuja na hin organise di summit.

U FIT ALSO READ Ministry dey request $8.92m World Bank loan for stationery and others

Shubham Chaudhuri tok say di World Bank don readi to support Nigeria in empowering girl child and youths, dis empowerment programme go help di countri achieve better things well well

Hin tok say di girl-child must go to school.so na di reason why world bank don provide $500 million to finance di programme and dey don readi to put anoda $700 million to make sure say di girl child go school.

Hin tok say di programme go touch up to 19 states from 7 states across Nigeria.

Shubham tok say di programme go affect both di girl child for school. affect primary health care, and provode maternal, child and reproductive health services.na government go dey in supporters of all dis thing wen hin mention.

Chaudhuri tok say since di world don rank Nigeria as di lowest in di world for public spending and revenues, and di states go need more support from external bodi to offer better service for hin indigenes.

Chaudhuri tok say to achieve all dis thing no bi wetin hard oo, only if Nigeria self don readi to make di right choices in adopting sound social policies and pay attenrion to key sectors of di countri like ( education, health, women empowerment, job creation/productive and decent employment )

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *