fbpx
March 29, 2024

Police don arrest one Man wen beat hin wife to death over property, inside Ogun state

0

One man for Ogun state, wen hin name bi Segun Ebenezer, don beat his wife, Bukola, to death.becos say she refuse to hand over di primary school wen she build give her husband.

According to wetin Ogun State Police Command yarn give tori pipol di man and hin wife don dey quarrel over di property before hin beat her to death.

U FIT ALSO READ I don construct more roads dan any governor for di history of Ogun state – Dapo Abiodun

Di police, pipol yarn dis one on Monday, say dey don arrest di man after one of di wife family send one voice note to police pipol wen di wife record bifore she die.

Di man no know say di wife don send one voice note give one of her family member and di voice note tok say her husband don use padlock to hit her for head wen hin dey beat her and if she die, make dem know say na her husband kill her.

As dem play di voice note give di husband hin con see say di leg of di dead bodi wen hin bury for ground don come out.

After di evidence, di Divisional Police Officer, Kemta division, Adeniyi Adekunle, tok say make hin detectives go after the killer husband and fish am out for ram him no care any where way hin dey.

Police pipol tok say dem trace di man sote dem con go find am for Akinseku village, Abeokuta, where hin go hide.

According to tori we hear say na carpenter work di man dey do bifore hin con tok say hin wan take over hin wife school.so na di reason why hin beat hin wife to dealth.

Di Commissioner of Police, CP Lanre Bankole, don direct di police detective to transfer di man go to homicide section of di State Criminal Investigation Department for further investigation and diligent prosecution.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *