fbpx
April 23, 2024

‘Yahoo Boy’ Kill Prostitute, Put Fire For Hotel Inside Delta

0
police-officers-IN-delta

Delta State Police dey on trail of one suspected internet fraudster wey pipo know as “yahoo boy” because hin stab one commercial sex worker to death. Di suspect put fire for di hotel, wey hin kpai di lady.

Pipo find out about wetin happen when dem see thick smoke as e cover di room for Nnebisi road, Asaba. Some pipo yarn say dem no know di man, dem no wetin happen, but di lady don kpai. Di man run comot after hin do wetin hin do. Dem talk say dem want make police help dem arrest di man so that hin go face di law.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

Di Delta State Police Public Relations Officer, (PPRO), DSP Bright Edafe, confirm di development, hin tell dem say di command dey check everywhere and dem go arrest di murderer.

This tori full ground for indie Leadership…READ MORE

For more news: Shine your eyes, no go enter scammers trap, Arik Air dey warns public

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *