fbpx
April 28, 2024

Yahoo boy trick me enter Nigeria – US victim

Yahoo-boy-trick-me-enter-Nigeria

Yahoo boy trick me enter Nigeria – Na wetin di US victim wey be United States citizen, Vonapolouis Moss explain give Kwara State Police Command.  Di Yahoo boy name na Joshua Awoyele, hin be  23-year-old Internet fraudster  “yahoo boy”.

Moss of 2962, W 64th Court, Merrillville, Indiana 46410, USA yarn say di  yahoo boy whine her make she come Naija on January 9, 2023.

On top di matter, she add say na for  di social media platform, TikTok na there she meet di boy.

FOR MORE NEWS: Dem pursue Arise TV cameraman comot for Tinubu event

“Yahoo boy trick me enter Nigeria”, Hin bin  claim to be American, e follow lie say hin name na Howard Adams and hin dey work for Nigeria.

As she dey narrate di incident, di state police command yarn say di suspected fraudster wey dey identified as Joshua Awoleye na Higher National Diploma student of di  Kwara State Polytechnic, Ilorin.

Hin whine di oyibo woman make she come Naija and hin scam her collect di sum of $1000 when she enter Nigeria.

“Yahoo boy trick me enter Nigeria”, Na wetin di Oyibo woman tok be that.

You go like read di full tori…READ MORE