fbpx
March 29, 2024

Yakubu yarn say some INEC official dey do Magu Magu as dem try enrol fake voters 40 times

0
Mahmood-Yakubu-INEC-fake-voters-matter-

Di Independent National Electoral Commission, INEC, don start in-house sanction of 23 officials because of dia magu magu.  Dem do multiple registrations of voters for di last voters’ listing exercise.

Di records of di commission show say some di 23 officials bi try register some fake voters 40 times, INEC National Chairman, Professor Mahmood Yakubu, announce am yesterday for di third quarterly meeting with political parties, for Abuja.

Ahead of next year general election, di electoral umpire yarn say 93.5 million Nigerians dey eligible to participate for di exercise as voters.

He mention say 12.29 million Nigerians don successfully complete dia registrations as new voters for di Continuous Voter Registration CVR wey just end.

Yakubu add say after dem use the Automated Biometric Identification System, ABIS do serious clean up, dem see over 2.78 million pipo as ineligible registrants and dem don comot dem now.

He yarn say di commission don identify 23 of dia registration officers for serious sanction as dem get mind try dey do magu magu with multiple registrations of Nigerians.

Di tori dey inside Vanguard…click here go read di full tori…READ MORE

For more News: Obaseki u dey tok nonsense with confidence-Fani Kayode

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *