fbpx
May 4, 2024

88 blind candidates sit down for 2023 UTME for Kano

88-blind-candidates-sit-down-for-2023-utme-for-kano

88 candidates who dey blind on Thursday sit down for di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) for Kano.

Na for Bayero University Kano (BUK) Center dem conduct di excercise, under di JAMB Equal Opportunity Group (JEOG).

JEOG is a programme wey dey designed to provide di opportunity to pipo wey dey live with disabilities, particularly blindness, to write di examination free of charge.

Di candidates, both male and female, collet different gadgets such as braille machines, typewriters, and braille paper to make di processes of the examination easy.

 

FOR MORE NEWS: Obi attack INEC for defending Tinubu, Atiku claim victory

JAMB coordinator for Kano Centre, Prof. Yahuza Bello drop dis known as hin dey monitor di exercise for di School of Continuing Education, BUK.

According to am, a total of 337 candidates living with blindness register to participate for di examination for 11 centres across di nation.

Also, hin yarn say di effort na in furtherance of Prof. Oleyede-led JAMB, to ensure say no eligible Nigerian dey denied di opportunity of taking di UTME and acquiring higher education regardless of disability.

“Since inception in 2017, the JEOG has processed over 3,300 candidates for the UTME, with more than a third admitted to courses of their choice in higher education institutions in Nigeria,” Na wetin Bello tok be dat.

You fit go read di tori see as 88 blind candidates sit down for UTME ..READ MORE