fbpx
May 4, 2024

Kwara university teacher, Ajaigbe Issa don kpai for hin sleep

kwara-university-dey-mourn-dia-lecturer

Kwara State University, Malete, don enter mourn following di death of Dr Ajeigbe Issa Yaqub, a lecturer for di institution.

Dr Ajeigbe, until hin death on Monday, na di Head of Department of Human Kinetics and Health Education and di Acting Director of Sports of di university.

A statement by Dr Kikelomo Sallee, Registrar of di university on Monday announce di death of di lecturer. Also, hin describe am as a committed member of staff.

Di statement console di family of di late lecturer, wey dem bury for Budo-Egba inside Asa Local Government Area of Kwara State, according to Islamic rites.

FOR MORE NEWS: Married Police officer shoot girlfriend dead over suspicion of cheating

Part of di statement read:  “With heavy heart, we announce the death of the Head of Department of Human Kinetics and Health Education and Ag Director Sports of Kwara state University, Dr. Ajeigbe Issa Yaqub.

“Dr. Ajeigbe kpai when hin dey sleep.

“As di University dey mourn di loss of a committed member of staff, dem pray make Allah forgives all hin shortcomings and admits an into jannatul firdaus.

“May Allah also console his family, friends and the University Community” Dr. Kikelomo W. Sallee, Dis na wetin dey inside di statement on Monday.

You fit go read di full tori of Kwara University wey dey mourn dia lecturer…READ MORE