fbpx
April 30, 2024

Make una Review 2023 budget for us biko, women group beg N’Assembly

0

Di National Council for Women Societies don tell di National Assembly to review di proposed 2023 budget, adding that di budget no even provide adequate resources for women’s economic empowerment at all at all.

National President of di NCWS, Lami Lau,yarn dis one for one press conference wen sele for Abuja on Wednesday.

U FIT ALSO READ Fisherman safe 24 people for plane wey crash, now millionaire

She been yarn say di issue wen concern di poor funding and low priority given to women’s economic empowerment in the 2023 proposed budget presented bi President Muhammadu Buhari (retd.) on October 7, 2022.

Among wetin she been yarn bi say,women empowerment allocation don drop by 56% from an allocation of N103 billion naira in 2022 to only a N58billion naira in di proposed 2023 budget.

Lau tok say di NCWS reviewed di 2023 budget con see di estimate submitted by Mr. President,dem bi shock to see am despite say Mr. President’s commitment to di economic advancement of our women,no any money in the budget to support women at all at all.

She con tok say on behalf of di group dem dey beg di National Assembly to review di budget and also called for adequate and proportionate funding for women in di economic activities.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *