Death Toll From Indonesia Earthquake don rise to 321
Di death toll from the earthquake wey hit Indonesia island of Java this week don rise to 321 as rescuers see more bodies on Sunday, di national disaster mitigation agency na hin talk this one.
Di shallow 5.6-magnitude earthquake hit di West Java town of Cianjur on Monday where most of di victims kpai as di building collapse.
YOU GO LIKE READ: Avoid These Top 10 visa Rejection Reasons
Disaster mitigation agency chief Suharyanto, wey like many Indonesians dey use only one name, tell one news briefing on Sunday say di rescuers see three body of pipo wey don kpai, and dem see Eight on Saturday.
“With di discovery of these three (bodies), as of today, di death toll don be 321 people,” na wetin Suharyanto yarn. As e dey so, Eleven people still dey missing.
This tori dey inside DAILYTRUST…READ MORE
For more news: 14 pipol don kpai and plenty pipol don woundjor, as earthquake happun for Indonesia