fbpx
March 29, 2024

“David, for where Chioma dey?” – Davido papa ask am as dem take family photo for his Uncle inauguration

0
Davido-step-out

Di Adeleke family dey for celebration mode as dem don swear Senator Ademola Adeleke in as di 6th Governor of Osun State.

Hin nephew, Nigerian singer, Davido wey don dey off social media and public eye since di death of hin son close to a month ago, dey spotted as hin come out celebrate with hin uncle.

YOU GO LIKE READ: 7 Tips to get sales for your business

Davido wey help hin uncle secure di seat of Governor for Osun state, dey spotted with dark shades and hin wear  blue native attire.

Di singer turn to trend on social media as fans dey happy to see am again as hin look good and healthy.

As di inauguration ceremony dey go on, di Adeleke family dey spotted as dem dey pose for camera and as dem dey do that one,  Davido papa ask Davido say for where Chioma dey.

This tori dey inside yabaleftonline…READ MORE

For more news: Town hall meeting abi wetin dem dey call am i no go show face – Tinubu

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *