fbpx
May 18, 2024

Akwa United boss dey positive about dia match against Nasarawa United

Akwa-United-boss-dey-positive-about-dia-match-against-Nasarawa-United

Akwa United head coach, Deji Ayeni dey positive about di chances of hin wards to win for Sunday Nigeria Professional Football League (NPFL). Dem go play three encounter against dia hosts Nasarawa United. Akwa United boss dey positive about di match wey dey come.

Di Promise Keepers neva record any win for di NPFL this season.

Ayeni side bin lose 2-0 to newcomers, Bendel Insurance for di opening day and dem follow hold eight-time champions, Enyimba to 0-0 draw for midweek.

FOR MORE NEWS: Seyi Olofinjana Don predict Arsenal vs Man Utd

Di Uyo club fail to hit di target for di two games despite di numbers of goal-scoring chances wey dem get.

But Akwa United boss dey positive, hin believes say things go better for his team this time around for di  New Jos Stadium.

Ayeni tell di official Akwa United website say e dey unbelievable as dem neva score after two matches. Dem don do plenty scoring drills for dia team so that any player go fit score at any time.

Hin finally tok say hin dey positive about dia chances to win on Sunday and dem go celebrate dia goals.

You fit go see di full tori…READ MORE