fbpx
May 18, 2024

Napoli wan offer Victor Osimhen €7m yearly contract

napoli-offer-victor-osimhen-€7m-yearly-contract

Napoli don prepare to break dia wage structure to keep Victor Osimhen for di club and dem wan offer am big salary more than di one wey hin dey collect now.

Di Nigerian striker dey enjoy great season for Napoli and hin don score 14 times for hin  19 appearances for all competitions for di ongoing campaign.

He dey involved with a move away from di Serie A giants next season, and multiple clubs across Europe dey interested in am.

According to AreaNapoli reports for Italy, dem claim say Napoli dey ready to break dia wage structure to keep di striker beyond next summer.

Dem get  maximum salary limit of €3.5m per year for any player, but Napoli dey prepared to make an exception for Osimhen.

Di club dey ready to meet di forward representatives and to offer am contract wey worth up to €7m per season.  Napoli believe say that one fit help them convince Osimhen make hin stay for at least one more season.

FOR MORE NEWS: killing of Joint Security members: Residents don run comot for Niger community

Although na big contract offer by Serie A standards. Manchester United, wey dey ready to sign di Nigeria international, dey in position to offer am more than that and Osimhen go surely want test himself for di Premier League.

However, if hin wan comot, Napoli still fit accept hin offers for di region of €120m for next summer. With di excellent form wey hin show this season, hin go get shortage of suitors once the transfer window opens.

E no dey surprising say di biggest clubs for Europe dey eye di striker because hin dey powerful. On top that one, hin get pace and hin be better finisher with a career record of 80 goals for 171 outings.

All these things na things wey dem expect say e go still dey rise because hin still be 24. Na all these things na hin make Napoli wan offer Victor Osimhen €7m yearly contract

You fit go read di full tori…READ MORE