fbpx
May 4, 2024

“Victor Osimhen dey on same level with Didier Drogba” – Jose Mourinho

victor-level-na-di-same-with-Drogba-mourinho

Roma manager, Jose Mourinho believe say Victor Osimhen dey on di same level with former Chelsea striker, Didier Drogba.

Osimhen score one better goal as Napoli defeat Roma 2-1 on Sunday night January 29, to extend dia lead for di top of di table to 13 points.

As dem dey tok during press conference after di game on Sunday night, dem ask Mourinho di comparison between Osimhen and Drogba.

FOR MORE NEWS: Napoli wan offer Victor Osimhen €7m yearly contract

Mourinho yarn say Victor dey di same level as Drogba, but Didier no dive. That is, e no dey take unfair advantage on di opposition team through falling, or to pretend say he don get injury.

In addition, hin yarn say if Victor change, then okay. Hin still tok say hin go buy am if hin dey for club with plenty money.

However, hin explain say if Victor go England one day, hin go need to change, because for Italy, dem dey fit cope with that kain behaviour, whereas for di  Premier League, dem go just come down hard on am.

Osimhen dey lead scorer in Serie A with 14 goals from 16 matches.

Hin compatriot, Ademola Lookman na second with 12 goals.

You go read d full tor HERE