fbpx
May 6, 2024

Alexx Ekubo and Fancy Acholonu audio conversation

Alexx-Ekubo-Audio-Conversation

E get audio conversation of Alex Ekubo and hin ex-fiancé, Fancy Acholonu wey don full internet.

For di audio conversation , Alexx Ekubo tell hin ex- fiance say hin no go post dia matter for hin page. Na di apology letter hin bin dey refer to. But hin yarn say hin go drop comment under di apology post.

Alex Ekubo, wey be one of di most eligible bachelor for Nollywood yarn say hin ex-fiance get something for mind and na hin make her write di apology.

He say Fancy for no write di apology note if to say she don see another person and she dey live for paradise.

FOR MORE NEWS: I no fit move my legs, I dey bedridden – Rapper Ikechuckwu don open up to Daddy Freeze

For inside di audio conversation, hin yarn say as she dey try do wetin she fit do make dem start dia relationship again, hin no see any harm there.

 

He tell her say make she go think am well, as na human being two of dem be.

“I have brain, you can think and process. I don’t want to go back, that’s not the bone of contention”. Na part of wtin hin tok for di recording be that.

You go like read di full tori…READ MORE