Alleged assault: Dem don release Ice Prince Zamani on bail, trial dey adjourned
Dem don release Nigerian star rapper, Ice Prince Zamani from Ikoyi Prison after hin meet with hin bail conditions.
The talented rapper lawyer, Folarin Dalmeida share this tori foe everybody on Friday, September 9, 2022.
But the lawyer Dalmenida carry two sureties go the court.
The court bin don grant am bail for the sum of N500,000 and make hin provide “two responsible sureties”.
YOU FIT LIKE TO READ THIS ONE: Lagos Police arrest singer Ice prince on top assault
Dem arrest Ice Prince Zamani for allegedly assaulting one police officer.
According to one statement wey the spokesperson of the Lagos State Police Command release, Benjamin Hundeyin, the music star abduct and hin kon threaten to throw the officer inside river after dem stop because e dey drive without a license.
You fit CLICK HERE go read more of this tori.