fbpx
April 19, 2024

Anikulapo: No be real Bimbo Ademoye’s Bobby show for the movie

0

Trending Anikulapo movie wey dey rock internet since the movie komot on top Netflix don get plenti reasons why those wey don watch the movie still dey talk about am.

One reason nah the way the Nigeria Oscar selection committee komot the movie from list of movie wey dem go present give the Oscar Academy for Award and recognition.

Another reason the nah the wey Bimbo Ademoye show Bobby for the movie. Why some netizen carry kudos give the actress for the wey she take act the movie, some dey reason say the actress go too far as she carry bobby show the whole world free of charge.

Well as the matter dey hot for internet, Hakeem Effect wey get the company wey do custom for the movie don come clear the mind of Bimbo fans and haters say wetin una see for the movie so no be real Bobby, nah prosthetics custom be that. According to Hakeem, he yarn say “it took my team and I hours to do this kind Bobby wey go look like original bobby.

Hakeem Effect nah one brand wey don become Ogbonge for the Nigerian movie industry on top say make dem do custom.

Meanwhile Kunle Afolayan’s new movie “Anikulapo” still dey chop praise dey go for Naija and beyond.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *