fbpx
May 5, 2024

Armed robbers dey kill, rob on Lagos-Benin road – Ogun PDP candidate lament

Di 2023 House of Assembly candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) for Odogbolu State Constituency, Ogun State, Lukmon Adeleye, dey lament base on di rate at which armed robbers dey attack pipol along Agoro-Okun Owa axis of old Lagos-Benin Road

Adeleye blame di government for not repairing di Agoro-Okun Owa axis of old Lagos-Benin road, hin too say di corridor don become den for criminals, “who dey kill innocent road users wey apply di road ”

U FIT ALSO READ Obaseki: We don tackle illegal human trafficking through education, and capacity building 

Ontop di road mata Adeleye, tok say na di same road dem take kill Amos Oyemachi for Odogbolu but yet dem never identify di persin wey kill am”

According to tori,Oyemachi, na member of di Kajola fish farmer of Yemule-Ikangba-Agoro Fish Farmers Association,as report tok say dem kill am on Monday and dey carry hin tricycle and other belongings waka

According to Adeleye, hin tok say na so many innocent pipol dey don attack, rob, kill just becos of dis bad road

Hin tok aay,“ this incident don dey happun several time now but still yet government and security operatives never see anything to do to ram.

Like dis like dis Adeleye don call both Federal and State governments to find  solution to di robbery attacks on di old Lagos-Benin road by fixing di bad road just to save lives and properties.

To read di full tori CLICKHERE