fbpx
May 18, 2024

“She sings in English, why she no go win?” – Reactions as Cameroonian singer Libianca beat Asake to win BET Award 2023

asake-miss-out-on-bet-award

Di BET Awards 2023 witness bittersweet outcome for Nigerian artists, with rising star Asake wey miss out on di Best International New Act award, BET wey bin dey claimed by Cameroonian vocalist Libianca.

While Nigerian sensation Burna Boy make history as hin secure di Best International Act award for the fourth consecutive time, no other Nigerian artist fit join am for di winner podium.
Libianca victory for di Best International New Act category for BET Awards 2023 don bring wave of reactions across Nigerian social media platforms, with plenty pipo wey express their dissatisfaction and dem label am as “daylight robbery.”

Asake, wey be talented artist signed under di YBNL label, na one of di contenders for di award wey dem dey eye.

However, hin loss to Libianca don trigger debate among fans and industry observers.

 

FOR MORE NEWS: Gov election: Elders council raise alarm over Kogi political violence

 

Some pipo on yarn say Asake defeat fit be because hin dey always sing Yoruba, hin indigenous language.

Di controversy surrounding Libianca win don highlighte di subjective nature of awards and di various factors wey come to play during  selection process.

While fans of Asake argue say hin music pass language barriers and e no suppose hinder hin chances of winning, others believe say international recognition dey always favors artists wey cater to a wider, more global audience.

Di outcome of dis year Best International New Act category don spark wider conversation about di impact of language and cultural diversity on award shows.

You fit go read di tori see as Asake  miss out on BET award…READ MORE