fbpx
May 18, 2024

Drama as Nigerian businessman no gree settle hin boy after 7 years

drama-as-boss-no-settle-boy

One Nigerian man don cause drama for hin boss shop as di man insist say hin no go settle am wey be hin boy after seven years wey hin serve am.

According to di young man, hin Oga suppose to settle am last January but hin no gree and hin ask am make hin wait until election finish.

Di young man bin dey heartbroken as hin boss listen to hin wife and together, dem take decision say dem no go settle am with a dime.

Also, in defence, di boss claim say hin shop don go down as di  young man claim say hin steal plenty things from hin shop.

Reacting to di tori, many netizens take sides with di young man and dem warn am make hin no comot without settlement.

E dey heartbreaking to see person wey don work so hard for so long, only to dey accused of theft without anything to show for am.

 

FOR MORE NEWS: “She sings in English, why she no go win?” – Reactions as Cameroonian singer Libianca beat Asake to win BET Award 2023

 

Martin Nancy reacted: “My cousin served his oga for good nine years on that year of settlement he came back as a mad man.”

Golden Jennifer reacted: “I told my younger brother not to steal from his boss anything at all so that when he finish serving and the man refused to settle him I go Waka.”

Austine Dominic said: “Even if he stole Oga settle am!!!”

CHUKS max Electrical reacted: “I remembered my own time with my boss after 8 good yrs I was settled with 150k I cried and cried nobody helped, but now the Almighty is at work.”

You fit go read di tori see di Drama as boss no settle boy…READ MORE