fbpx
May 18, 2024

Atiku, Peter Obi: Court must sack Tinubu if hin no win election – Sam Amadi

sam-amadi-give-conditions

Di Director of di Abuja School of Social and Political Thoughts, Sam Amadi, on Friday, don give conditions make dem to kick out President Bola Tinubu.

Amadi yarn say dem need to kick out Tinubu if hin no win di last presidential election fairly.

Hin make di call as hin fault di pipo wey dey argue say di presidential candidates of Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar, and Labour Party, LP, Peter Obi, need to drop dia case against Tinubu for di presidential election tribunal.

Tweeting, di public affairs analyst yarn say e dey foolish to ask di pipo wey dey aggrieved say make dem drop dia case make Tinubu administration to succeed.

 

FOR MORE NEWS: Beyonce donate £8,000 to Nigerian restaurant for North London

 

Na wetin Amadi tok be dis: “It’s foolish to argue that aggrieved persons should drop their case so that Tinubu presidency can succeed. Why are we always in search of plastic heroes?

“In the 1960s, African intellectuals preached the one-party state for national dev. We got neither democracy nor development.

Also, hin yarn say Tinubu no be di first person wey go dey sworn in as President. In addition, hin tok say  no “development” dey wey suppose trump establishing di fairness and freeness of di 2023 polls. If Tinubu no win fairly, make dem kick am out. Dat na national development.

You fit go read di tori as Sam Amadi give conditions…READ MORE