fbpx
April 26, 2024

Atiku, Obi, Kwanwkaso no fit match Tinubu’s records-Alake

0

Director of Strategic Communication for di All Progressives Congress (APC) Presidential Campaign Council,Dele Alake don talk sey dem no fit compare Asiwaju Bola Tinubu with other pipu wey dey follow him drag sit.

According to Wetin Alake talk, Former Vice President Atiku Abubakar , Rabiu kwankwaso and Peter Obi wey dey run katakata for presidential seat no fit match Wetin Tinubu don record.

YOU FIT LIKE READ: No more Okada activities from today, Lagos govt insist.

He kon add am join sey pipu wey dey use mouth pull oga Tinubu down na because dem never get half of wetin he get sey na why dem dey envy him.

Alake talk sey pipu wey know di value of wetin Tinubu don do na hin dey support and dey praise him, he talk sey Atiku, Obi, Kwankwaso and others too don hold public offices too before but dem never get all di achievements wey oga Tinubu don get. Oya shook eyes join. READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *