fbpx
May 18, 2024

Angry Awoniyi don fire back hin fan over Premier League flop post

awoniyi-premier-league-flop

Nottingham Forest striker Taiwo Awoniyi don counter claims wey tok say hin flop for di Premier League. This na just six months after hin enter di City Ground.

Di 25-year-old Nigerian striker go make hin return to England after hin don spend six seasons with Liverpool, but fail to make first-team appearance.

Awoniyi bin join Bundesliga side Union Berlin, where hin score 25 goals for 65 appearances.  Na that move na hin ginger Forest make dem move for di forward during summer to build squad wey go compete for di  Premier League after promotion from di Championship.

But the striker don struggle for form and hin manage five goals for 19 appearances for all di  competitions for Forest. As di matter be now, hin dey sidelined with injury.

FOR MORE NEWS: “Victor Osimhen dey on same level with Didier Drogba” – Jose Mourinho

Twitter user Mavs69 @Mr_jb_Maverick, reply to one tweet, and hin tag Awoniyi, Claudio Pizzaro and Emmanuel Dennis Premier League about dia flop.

Na wetin hin write for di tweet be this, “Did you forget or intentionally omitted Kezmam, Claudio Pizzaro, Emmanuel Dennis, Taiwo Awoniyi and the others that came with higher reputations flopped heavily? The EPL is different in terms of pace and space and you know it, stop being a hypocrite.”

As Awoniyi see di tweet, e vex am wella. That one sef make am respond to di guy. Hin tell di @Mr_jb_Maverick, wey dey bash am ay hin no get understanding and knowledge of football.

You fit go read di full tori…READ MORE