fbpx
May 18, 2024

“Think before you sing, wetin be 10 girls on my bed” – Portable don bash Wizkid over verse on Abracadabra remix

portable-bash-wizkid-over-abracadabra-verse

Controversial singer, Habeeb Okikiola, a.k.a Portable Omolalomi, again don make am to headlines with hin latest video wey hin publicly bash Wizkid over verse.

One video capture Portable as hin dey bash di Grammy winner Wizkid for hin verse on music producer, Rexxie’s ‘Abracadabra Remix’. Portable announce say Wizkid need to learn how to make songs with more meaningful lyrics.

He blast di ‘Essence’ hitmaker over di line, “ten (10) girls on my bed, all of them n@ked undressed.”

FOR MORE NEWS: Police don declare Ebonyi APGA governorship candidate wanted

Speaking further, Portable bash Wizkid because hin use dat kain lyric for hin song. Also, hin yarn say Wizkid need to dey think critically about lyrics before hin release any music.

According to Portable: “Before you release any song make sure di song goet reasonable meaning. wetin be di di meaning of 10 girls n@ked on my bed?”

Hin still ask Wizkid weda hin no fit praise God or sing about things revolving around reality.

You fit go read di full gist…READ MORE