fbpx
May 17, 2024

Customers dey fight over N5000 over-the-counter payments

customers-dey-fight-for-5000-for-over-the-counter-payments

Di scarcity of di naira wey no wan end don increase di hardship of plenty bank customers. Also, di matter don force customers join long queues and dem dey fight to withdraw N5000 over-the-counter payments. This matter don increase di frustration of plenty customers wey dey wait to collect cash and e don lead to heated exchanges and fight for queues for over-the-counter payments.

On Thursday, reports show say bank branches for Lagos and Abuja get plenty queues and plenty Nigerians dey struggle to withdraw cash from dia accounts.

Inside plenty of these banks, di ATMs no dey dispense. Customers for Zenith Bank Plc branches for First Avenue, FESTAC and First Gate, complain say dem no see cash withdraw.

Also, di cash wey dem no see collect na hin cause fight between customers over N5000 for over-the-counter payments

FOR MORE NEWS: Banks go close branches early ahead of polls

One bank official wey put mouth for di matter yarn say di First Gate branch of di bank blamed network downtime for dia inability to attend to customers.

Di official yarn say for some time now, dia network dey down and dem no fit do plenty things because of that matter.

Although for Polaris Bank branch around di area, customers dey allowed to withdraw N4,000. Customers of both Fidelity Bank Plc and Access Bank Plc for dia  branches for First Gate, Old Ojo road confirm say dem fit withdraw N5,000.

You fit go read di full tori…READ MORE