fbpx
May 18, 2024

‘Devil is a liar’ – Banky W don respond to allegations wey tok say hin cheat on hin wife, Adesua

banky-w-don-repond-to-cheating-allegations

Popular Nigerian singer-cum-clergyman, Bankole Wellington, aka Banky W, don respond to di cheating allegations against am.

Controversial blog, Gistlover, bin tok something wey be like say di singer dey cheat on hin wife, actress Adesua Etomi-Wellington with hin former signee, Niyola.

However, as hin dey address hin congregation for di Waterbrooks church for Lagos on Sunday, di rapper-turned-preacher yarn say di rumours come from satanic elements wey no want make hin members listen to hin Sunday sermon.

 

FOR MORE NEWS: Police gun down notorious robbery suspect for Delta

He declare say di devil na liar also hin assure hin congregation say dey God dey in control.

In addition, hin tell di congregation say devil no want want dem di message wey hin wan preach to dem.  In fact, devil no want make hin enter di series at all. Dis na wetin hin tok as hin yarn say di devil na liar. And God dey in control.”

As hin dey Preach on di topic, ‘The Prison Of Pornography’, Banky W appreciate hin wife, Adesua, for her support for am during hin struggle with porn addiction.

You fit go read di tori as BankyW don respond to cheating allegations against am…READ MORE