fbpx
May 18, 2024

Banky W don break silence as he lose Eti-Osa Reps seat to Labour Party

banky-w-don-break-silence

Nigerian singer, Bankole Wellington, aka Banky W, don break di silence as hin tok about hin loss to di candidate of Labour Party for di  just concluded Lagos State Eti-Osa Federal Constituency election.

Banky W lose to Labour Party candidate, Attah Thaddeus.

However, Attah win di election with 24,075 votes.

Reacting on hin Instagram page on Monday, Banky W yarn say if things don go according to plan, he for don trave go get apartment and office space for Abuja.

As Banky W break di silence for hin church, hin yarn say faith in God no mean say person no go get hurt.

 

FOR MORE NEWS: EPL: Arsenal favourites go sign Osimhen ahead of Man Utd, Chelsea

 

In Banky W word, “For anyone wey ever suffer through loss, disappointment or situation where things no just work out di way you hoped. ‘Faith after fall’ na for you, for me.” Na wetin Banky tok be dat.

Hin tok say dat Sunday suppose be dia Thanksgiving service. After di election dey over, dem come celebrating and  thank God. Alo, hin yarn say he plan to give short charge to say see wetin God don do for am.

See below di remaining tok from Banky;

“And then, we use that to build up your faith and give God some praise. Then we finish the service and I go to Abuja to start looking for apartment and office space.

“Your faith in God does not stop you from hurting, but it helps you heal, and it helps you deal,” Na wetin he tok be

You fit go read di full tori…READ MORE