fbpx
May 18, 2024

Actress Funke-Akindele’s ex-husband JJC Skillz don finally react to rumour of secret marriage

jc-skillz-rumor-of-secret-marriage

Popular Nollywood actress, Funke Akindele ex-husband, JJC Skillz don react to reports wey dey make rounds say hin do secret marriage.

Reports make di rounds online say di 45-year-old rapper tie di knot with a Kogi-born lady, Falilat Raji, for private ceremony inside Kano state.

 

FOR MORE NEWS: “Na di pattern be dis”- Netizens don react to claim of JJC Skillz wey move go hin new wife house for Abuja

Di report yarn say hin don find love again and he don give marriage another shot only nine months after he announce hin split from actress turned politician, Funke Akindele.

According to reports, photos and videos wey capture di couple together bin no dey in circulation because of JJC no gree allow anybody take photos for di event.

However, one rare photo of JJC Skillz and hin allege new wife wey hin do secret marriage for don later appear online. Also dem yarn say na JJC Skillz personal photographer na hin take di photo.

Reacting to di report, inside new interview with popular media outlet The Cable, di music producer yarn say he no go publicly announce hin decision to remarry.

“If I decide to marry or choose which way I want to go, it will be a personal choice and I will not make it public”, Na wetin hin tok be dat.

Meanwhile, JJC Skillz son, Benito, follow confirm di report when he troll am (JJC Skillz) for remarrying.

You fit go read di full gist…READ MORE