fbpx
April 26, 2024

BBTitans Blue Aiva appreciate fans for supporting her

bbtitans-blue-aiva-appreciate-fans

Controversial BBTitans housemate, Blue Aiva don appreciate fans with message to thank  fans wey stand by her all through her stay on di show.

E don reach about 2 weeks wey Blue Aiva comot for di show, and as she comot,  she take some time off social media. When she still dey on di show, she bin dey known as di “Operator”.

During an interview with Ebuka after her eviction, she share say she loves to cause trouble and she hates silence, so na wetin cause her troublesome self on di show.

FOR MORE NEWS: Gospel singers, Mercy Chinwo and Minister GUC don unfollow dia sef for Instagram

Following her return to social media, Blue Aiva take to her official Instagram page, where she appreciate her fans wey support her during her journey.

She yarn say na with great pleasure she dey announce her come-back after a well needed self care.

Also, she yar say her heart dey full of gratitude . She yarn say as she walk in to di big brother house as Blue Aiva, she come out as a Diamond 💎 of Blue Aiva The Brand.

In addition, she yarn say di journey na emotional roller coaster.

You fit go read di tori…READ MORE