fbpx
May 18, 2024

Beyonce donate £8,000 to Nigerian restaurant for North London

beyonce-donate-to-restaurant

Beyonce, di American singer, don donate £8,000 to one Nigerian restaurant for North London wey be like say e go soon of close down because of di rising energy costs.

Chuku, wey claim to be di world first Nigerian tapas restaurant, dey handled by siblings Emeka and Ifeyinwa Frederik.

Dem dey among di ten recipients of grant from Beyonce Renaissance World Tour foundation, BeyGOOD.

Also, di foundation don pledge to donate a share of $1 million (£806,000) to ten businesses for di cities around di world, and di Nigerians were fortunate to be among di top ten.

Di business open not too long after Covid pandemic start in 2020,and di owners claim say lockdowns and di cost of living crisis don destabilize dia business.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu go meet US, French, Swiss leaders for Paris summit

 

Also, Luckily for di siblings, dem don collect extra boost from Beyonce foundation. Dis na with di grant wey dem collect during di Black Parade Small Business Impact Luncheon, created by BeyGOOD to ‘celebrate pipo, communities, and small businesses wey dey impacted by economic inequities worldwide’.

Chuku co-founder Emeka tok dis one as dem win: ‘This grant couldn’t be more welcome. Chuku’s, like other restaurants that don’t have a financial reserve, has been battered by lockdowns and the cost of living crisis.

While hin sister Ifeyinwa add: ‘I still can’t quite believe that Beyoncé has backed our restaurant – it feels a bit surreal.

You fit go read di tori as Beyonce donate to Nigerian restaurant…READ MORE