fbpx
May 18, 2024

Tinubu go meet US, French, Swiss leaders for Paris summit

tinubu-meetings-for-paris-summit

President Bola Tinubu go hold bilateral meetings with hin counterparts, or dia delegations, from France, di United States of America, Sweden and two others for di Paris Financial Pact Summit, wey go start on Thursday.

Di Special Adviser to di President on Special Duties, Communication and Strategy, Dele Alake, wey speak with journalists for Paris, yarn say di request for meetings with Tinubu na obvious offshoot of hin administration economic policies wey hin implement for di past three weeks since hin assume office.

Also, Alake tell journalists for Paris on Wednesday say many international financial institutions dey willing to see am.

 

FOR MORE NEWS: Gas explosion kill 31, injure seven for China restaurant

 

Di presidential spokesman tok say di two-day summit go enable Tinubu, wey dey on hin first foreign trip since hin inauguration, to network and attract foreign direct investment to di kontri.

Alake explain say di President wan network with international finance Corporations and kontries wey go facilitate foreign direct investment into Nigeria.

Also, hin tok say Apart from di immediate, medium and long-term positive effects of di unification policy, Alake yarn say there fit be need for an injection of direct foreign exchange into di economy to shore up di value of naira while market forces stabilise.

You fit go read di tori of Tinubu meetings for Paris summit…READ MORE