fbpx
May 4, 2024

I go love work with Ayra Starr, Tems, Portable – Bloody Civilian

bloody-civilian-wan-collaborate-some-artists

Nigerian singer-songwriter and producer, Emoseh Khamofu, wey dey better known as Bloody Civilian, don reveal di artists wey she go love to collaborate with. Di multi-talented music star, Bloody Civilian yarn say she wan collaborate with Asake, Seyi Vibez, Ayra Starr, Tems, and controversial singer, Portable.

She reveal dis tori inside recent interview with Max 102.3 FM, Lagos.

Na wetin she tok be dis, “I would love to work with Asake, Seyi Vibez, Ayra (Starr), Tems, and Zazu; Portable.”

 

FOR MORE NEWS: Popular American rapper, Big Pokey don kpai on top stage

Whewn dem ask herwhy she included Portable, Bloody Civilian yarn say, “You know say, pipo dey listen with di vibes. Also, she yarn say if she listen to Portable vocals, hin remind her of Terry Apala but less English.”

Before Bloody Civilian don work with Rema on top di American superhero movie Black Panther 2 soundtrack ‘Wake Up.’

You fit go read di tori see wetin Bloody Civilian tok as she wan collaborate with some artists…READ MORE