fbpx
May 4, 2024

Charly Boy don threaten to sue company over claim of breach of contract

charly-boy-threaten-to-sue-company

Veteran entertainer Charles Oputa, wey dey popularly known as Charly Boy, don threaten to sue company wey dey know as Premier Records Limited over alleged violation of terms of agreement for musical contracts wey dem sign about 35 years ago.

Hin tok dis matter inside letter wey hin write to di record label through hin lawyer, Mr Rockson Igelige, wey make am available to Newsmen on Wednesday for Abuja.

Inside di letter, di date na June 19, 2023, di lawyer tok say Charly Boy bin sign Artists Recording Contracts with di company in 1988, 1990 and also recently.

However, hin claim say di contracts don expired since, but Premier Records still dey breach hin client copyrights to di musical works.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Ex-Governor Ortom present himself to EFCC for Makurdi

 

Di lawyer tok say on hin client instructions, dem ask di company make dem handover dia client master tapes, artworks, promo collateral for di music and other relevant and confidential information with di company within 30 days of di date of di letter.

Also, hin demand di company payment of dia client outstanding royalties, na part of wetin di letter read in parts be dat..

According to Igelige,  di albums wey dey affected na di one wey hin record 1990  containing songs like Big Bottom, Aids, Sexy Lady, Mama, and Nwata Miss.

 

You fit go read di tori as Charly Boy threaten to sue Premier Records Limited company…READ MORE