fbpx
May 4, 2024

Popular American rapper, Big Pokey don kpai on top stage

popular-rapper-big-pokey-don-kpai

Popular American rapper Milton Powell, wey dey professionally known as Big Pokey, don kpai.

Di 45-year-old singer collapse on top stage as hin dey performing for one bar wey dey Beaumont, Texas, on Saturday night.

Footage from di event show di Houston-born rapper with mic for hand as hin dey tok with one DJ on stage, as hin breath out heavily, hin stagger kon fall for ground.

Also, di incident bin dey confirmed inside statement on top di rapper verified Instagram page.

 

For on top hin page, dem write say na with deep sadness dem share di news of di passing of dia beloved Milton ‘Big Pokey’ Powell.

Na there dem tok am say “Big Pokey don kpai.

Also, di person write say hin bin dey well-loved by hin family, hin friends, and hin loyal fans. In addition, dem tok say in coming days, dem go release information about hin celebration of life and how di public fit pay dia respects.

However, di person beg pipo make dem respect Big Poko family and dia privacy during dis difficult time.

You fit go read di tori…READ MORE