fbpx
May 18, 2024

Why My ‘Colleagues’ Sleeps With Producers For Roles – Nollywood Actress Ruby Orjiakor don Open Up

why-actresses-sleep-with-producers

Nollywood actress, Ruby Ojiakor don open up on why actresses dey sleep with film makers. She yarn say dem no dey good with wetin dem dey do, and na why dem see di need to compensate di filmmakers with dia body.

According to di single mother for recent interview, she yarn say only those wey dey desperate for fame and no care for progression for di career na hin dey allow themselves to dey used by any producers to satisfy dia sexual urge.

FOR MORE NEWS: Johnny Drille and Tomi Ojo don spark dating rumors

Also, when dem ask about her take on di issue of sexual harassment wey dey happen for di movie industry, she yarn saye dey good when actress dey talented and knows wetin she dey do.

She yarn say plenty of di girls wey prefer to sleep with filmmakers no dey and dem just dey desperate, and wan become overnight stars.

“If one is not desperate and one keeps praying to God, one will get movie roles, even if one does not sleep with filmmakers. The filmmakers will not have any option in such a case because the person is good. It is important for actresses to always work on themselves. Once they do so, they will always get jobs. I still get calls despite turning down sexual advances from producers.”

You fit go read di tori on wetin Ruby tok on why actresses sleep with film makers…READ MORE