fbpx
May 18, 2024

Lagos Government don trash ’Gangs of Lagos’ movie over cultural misrepresentation

lagos-government-accuse-promoters

Di Lagos State Government don release statement wey accuse promoters of di movie ‘Gangs of Lagos’ say dem make mockery of di heritage of Lagos.

For inside di statement wey dem post on top di state government official website: “Lagos State Government express displeasure with di promoters of di “Gangs of Lagos” film/series. Dis na because of di cultural misrepresentation and for portraying di culture of Lagos State in a derogatory manner.

“A release wey dey signed by di Commissioner for Tourism, Arts and Culture, Pharm. (Mrs.) Uzamat Akinbile-Yussuf yarn say di Ministry, being the regulatory body and custodian of the culture of Lagos State, views the film/series as a mockery of di Heritage of Lagos.

Also, di Commissioner express her disappointment with di promoters of di film, Jade Osiberu and Kemi Akindoju, for portraying di Eyo Masquerade as a gun-wielding villain even as he wear di full traditional regalia.”

FOR MORE NEWS: China don report di first human death wey bird flu cause

According to di statement, Uzamat Akinbile-Yussuf yarn say dem dey of di opinion say di production of di film ‘The Gang of Lagos’ dey very unprofessional and misleading. Dis na because di content dey derogatory of di culture, with di intention to violate di respected heritage of di pipo of Lagos.

In addition, di statement yarn say na unjust profiling of pipo and culture as being barbaric and shameful.

Akinbile-Yussuf maintain say di Adamu Orisha, wey dey popularly known as di Eyo Festival, dey rarely observed and e dey only come up as a traditional rite of passage for Obas, revered Chiefs and eminent Lagosians.

However, Nigerians don condemn di statement wey di Lagos State Government drop on top Twitter.

You fit go read di tori wey Lagos Government accuse promoters over cultural misinterpretation….READ MORE