fbpx
April 19, 2024

BREAKING: If we release all Ayu sins, hin children go disown am – Wike

0
Wike-and-Ayu

Rivers Governor Nyesom Wike yarn say if dem talk the sin of the National Chairman of the Peoples Democratic Party (PDP) Iyorchia Ayu even hin children go disown am.

Hin say, if people know wetin we know, if we release wetin we get, Ayu children go meet am tell am say dem no be hin children again.

As dem dey talk for live media chat for Port Harcourt, Rivers State, on Friday, the Governor yarn say Ayu no suppose stand before Nigerians and campaign for PDP ahead of the 2023 general elections.

YOU STILL FIT ENJOY: 2023: Why be say Tinubu dey always dey for news – APC chieftain, Oyalowo

The Governor no change mouth, hin talk say the PDP boss no get integrity and hin allege say the chairman collect money two times for one project.

For the N1billion wey hin accuse Ayu say hin collect,  na wetin Wike yarn be this: “There cannot be any comment. He (Ayu) cannot say anything. Look, I am the governor of Rivers state and I don’t just come out to speak.

You fit CLICK HERE go find out more of wetin dey happen for this tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *