fbpx
May 4, 2024

Brymo apology dey sincere – Management

Olawale ‘Brymo’ Ashimi’s manager, Ortega Kakawa don open up say di singer bin tender sincere apology following hin comments against Igbos for Twitter. Hin yarn say Brymo apology dey sincere.

Na for inside Instagram live hin apologise for hin comments about di Igbo people.

For di apology, hin tok say e no insult di tribe, e dey sorry to anyone wey e sound like that too. E explain say hin bin dey try weigh into matter wey dey very important.

FOR MORE NEW: Mercy Johnson cancer health scare

But di way wey di matter be now, plenty pipo dno gree accept di musician apology because dem feel say hin apology no genuine.

Hin manager, Ortega Kakawa for interview with assure Nigerians sayb hin apology sey sincere and no be because pipo expect am to apologise.

“Brymo don apologize to di entire Igbo on top hin Twitter space and Instagram live. Di entire management follow send heartfelt sincere apology to every Nigerian for di country and for diaspora wey e affect. Brymo apology dey sincere, We hope say every petition wey dey signed against am go dey nullified in good light.” This na wetin di manager tok.

You fit go read di full tori…READ MORE