fbpx
April 29, 2024

Na hin papa carbon copy – Netizen Reactions to Regina Daniels second son

Na-hin-papa-carbon-copy

Plenty fans for social media don dey react to di photo of Khalifa face wey Regina Daniel post. Netizens yarn say di resemblance between him and hin billionaire father, Ned Nwoko dey like say tomorrow no dey. Na hin papa carbon copy.

Nollywood actress, Regina Daniels, don enter social media for her Instagram post share adorable video of her second son, Khalifa.

For inside di beautiful video wey di mama of two share on top her Instagram page, di toddler bin dey laugh with hin brother Munir.

As Regina Daniel share di video, she tok say di laughter dey unusual and say na only hin big brother fit make am laugh like that.

FOR MORE NEWS: Mercy Johnson cancer health scare

Na her caption for di video be this:

“This is a once in a while laugh from Kharl 😂😂 …. And only moon has the power to do that 😂😂 ….. @princekhalifanwoko”

One Instagram follower @itsvibesangel_ write, “This one na hin papa carbon copy😍

@chinnycynokoye write, “This one na him papa complete !”

@queeneth_ozioma, “Na this one be my papa born me no DNA required”.

You fit go read di full tori…READ MORE