fbpx
May 19, 2024

Buhari congratulatory message na hin dey responsible for Morocco loss to France – Omokri

0
Morocco-loss-to-France-Buhari-Effect

Former presidential aide Reno Omokri don yarn say Morocco loss to France na because of di congratulatory message to them by President Muhammadu Buhari.

Buhari, for statement by hin Senior Special Assistant on Media and Publicity, Mallam Garba Shehu congratulate di Moroccan national football team as dem beat Portuguese national team wey make dem advance to di semi-finals of di ongoing FIFA World Cup Qatar 2022.

FOR MORE NEWS: Qatar 2022: Messi, Argentina na Very difficult team to play against – Griezmann

He still yarn say di Atlas Lions dey capable of winning di tournament.

Before Morocco match against France, di former presidential aide, argue say Buhari no get business to dey congratulate Morocco.

Omokri mean say di congratulatory message from Buhari fit get negativeeffect on di African team.

Following di abortion of Morocco dream from moving to di finals after dem suffer big defeat from France, Tableshaker for series of hn tweets tagged their loss as di ‘Buhari Effect’.

You fit find di tori here…READ MORE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *