fbpx
March 29, 2024

Burna Boy to release new music documentary today

0

Di Grammy award winner, Burna Boy, don come out tell pipol di date wey hin go release hin new music documentary titled “Whiskey.”

Di Afrobeat musician make di announcement on hin Instagram page on Tuesday, posting one small video clip from hin upcoming documentary and hin tok say hin go release am on Thursday

U FIT ALSO READ Seun Kuti don react over D’banj detention case over fraud matta 

Burna Boy wey bi di advocate persin for di pipol of Niger Delta, and with hin new documentary, hin want call di whole world into attention to di kind predicament wey dey befall pipol for di area of Niger Delta.

Hin bin caption di clip with one English like dat wey he tok, ” We let the people tell their stories.
Di African giant go release di Whiskey mini-documentary video today Thursday by 7 p.m. (WAT).

Dis documentary go focus on how dem dey take extract oil and how di oil matta don take distroy di Niger Delta’s ecosystem.

According to research, di pipol of Rivers State dey die slowly as a result of di oil pollution caused by illegal oil refining.
Di documentary go still expose on how ineffective di regulatory bodies and security personnel dey treat di issue.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *